Nigeria Defense Minister, Christopher Musa don confam to BBC say one small team of US troops dey operate for di kontri.
E say di US military go be “training team to prepare our troops for operations”.
Di minister no give details about di size of di team, wen dem land, wia dem base, or how long dem go dey for Nigeria.
Di United States Africa Command (Africom) – wey dey responsible for military relations between di US and kontris and organizations for Africa – bin say a “small team” of dia troops don enta Nigeria to help di Nigeria military wit dia ongoing fight against terrorists for di northern region of di kontri.
General Dagvin Anderson wey be di head of Africom confirm di development to tori pipo on Tuesday, according to report by Reuters.
Oga Anderson say di deployment na based on agreement between di two kontris say dem need to do more to fight terrorism for di region.
“Dis don lead to increased collaboration between our nations wey include a small US team wey go bring some unique capabilities from di United States,” Anderson tok, but e no provide any details about how many di soldiers be, exactly wen dem arrive di kontri and wetin exactly dia work go be.
Skip content and continue reading
Saif al-Islam, Muammar Gaddafi son die after one ‘four man commando’ unit shoot am according to reports
7 hours wey don pass
End of content
Dis development na follow up from di airstrikes wey di US military bin carry out on top hideouts of Lakurawa terrorist group for Sokoto State on Christmas Day of 2025.
Nigeria Minister of Defence Christopher Musa, for one interview wit BBC, bin confirm say di Nigeria and US military continue to dey join bodi since to wipe out di violent extremists wey don dey disturb di kontri, especially afta di December 25 airstrikes for Sokoto State.
For dat interview, Musa too no gree give details on exactly how di collaborations go be.
However, one former U.S. official tell Reuters say di “U.S. team be like say dem dey heavily involved for intelligence gathering wey go help di Nigerian forces to strike di terrorist groups.”
Earlier for January, di US bin deliver military supplies to Nigeria to improve security operations for several parts of di kontri.
Di US Africom bin announce am for one post for dia X handle say: “U.S. forces bin deliver critical military supplies to our Nigerian partners for Abuja. Dis delivery support Nigeria ongoing operations and emphasize our shared security partnership.”
‘Trump no happy wit killings for Nigeria’
Remember say di US President Donald Trump bin accuse di Nigeria govment say dem dey sidon look as Christians dey face “genocide” for di hands of Islamist extremists for Nigeria.
“Dem dey kill a large amount of Christians for Nigeria, dem dey kill dem in record numbers and we no go allow dat one to hapun,” Trump tok for one interview on top Air Force One.
And dis na afta e don post for im social media platform, Truth Social, say Christianity dey face “existential threat” for Nigeria and say e dey list di West African Nation as a “kontri of particular concern”, and if tins continue like dat, e fit send troops to enta Nigeria “guns a blazing”.
‘Kontris of particular concern’ na list wia di US govment dey put kontris wia dia govment dey violate religious freedom. Kontris like China, Myanmar, Russia, North Korea and Pakistan also dey for dat list.
Howeva, Nigeria President Bola Tinubu deny di accuse say Christians dey face any kind of threat or discrimination for di kontri.
Im administration argue say di insecurity wey dey hapun especially for di northern region of Nigeria dey affect both Christians and Muslims alike, bicos di Boko haram terrorists don destroy plenty mosques and kpai plenty Muslims also.
Since di US remarks about targeted violence against Christians for Nigeria, several attacks don hapun, including di kidnap of 38 pipo from dia Church for Kwara State, di more dan 200 students and teachers wey bandits kidnap for Papiri, Niger State, and more recently, di kidnap of more dan 150 pipo from three churches for Kaduna State.
Dis last incident hapun on 18 January 2026 as pipo dey attend Sunday service for Kurmin Wali village, for Kajuru local govment area of di state.
Di US govment, through dia Under Secretary for Political Affairs Allison Hooker wey bin meet wit di Nigeria National Security Adviser Nuhu Ribadu, also cut warning say dis kain violence against di Christian population must to stop.














