BREAKING: How Nigeria police gbab 20 pipo for alleged attempt to take ova state secretariat

Di Oyo State goment secretariat bin come under attack on Saturday morning, as one group of alleged jaguda pipo bin try take ova di di goment offices by force.READ FULL ARTICLE HERE>>>>

Di suspect wey di Oyo State Police Command say na suspected members of one separatist group, Yoruba Nation Agitation Group, bin attempt attack around 9:15 am.

Machetes wey police seize from di separatist group

Wia dis foto come from, Oyo State Police Command

Wetin we call dis foto, Some of di weapons police say di suspects carry

Di bus bin carry weapons like cutlass, pumpaction gun, bullets, assorted charms and an O’dua Nation agitation flag, police tok.

Police say dem arrest 20 suspects as dem wan commit di “unpatriotic”, “treasonable felony & terrorism”.

Di police no tok why di group wan kolobi di state secretariat.

items wey police seize from di separatist group

Wia dis foto come from, Oyo State Police Command

Wetin we call dis foto, Some items wey police say dem recova from di suspects

Dis no be di first time wey police go dey make dis kain arrest.

for May 2023, Nigeria police arrest five suspected Yoruba nation members wey bin try to take ova broadcast activities for Amuludun FM one early Sunday morning, for di state capital, Ibadan.

“Could Care Less About That”: Stephen Curry Disappointed by Tonight’s Loss, Shifts Focus on Upcoming Challenge

Di suspect allegedly invade di radio station to show say dem dey provoke say di station refuse to regularly broadcast dia activities.

Bullets wey police seize

Wia dis foto come from, Oyo State Police Command

Wetin we call dis foto, Bullets wey police say dem recova from di suspects.READ FULL ARTICLE HERE>>>>